A B C D E F G H I J K L M N O P Q R S T U V W X Y Z #

FELA KUTI lyrics : "Power Show"

I open my eye I see for my land
*(CHORUS) NA WRONG SHOW O
Everywhere you go

Everywhere you dey
Everybody want do power show


Na wrong show O

You reach boarder immigration

officer dey
Him go bluff you
Waste your time

Change him pants
Some dey comb dem hair
Den tidy dem table

Den dem pull dem chair
Before him go know say you dey there
If you no talk quick

Him go go for %#@!
Him go %#@! come-back
And you talk to am

Then you suprise when him
Shack for you
Him go say you no go cross

You no go cross today
Na that time dem go start Dem
Power Show O O


Na wrong show


Go post office na the same
Dem go bluff you
Waste your time

Run you up
And then run you down
Dem go tire your body

And then tire your mind
And them tire your whole mind
Dem go say no change for fifty Kobo

Na that time dem go start them
Power Show O O


Na wrong show O

Motor car owner sef him go take

him car push him car push laborer
Down for road
Then him start to yab

Foolish labourer
Nonentity, him no get money
Look him sandals e don tear finish

Look him trouser e don tear for yansh
Look him singlet e don dirty finish
Look him body e no bath this morning

Look him pocket e don dry finish
You go suffer for nothing
You go suffer for nothing

You no know me sha?
I be General for Army Office I
I be Officer for Police Station

I be secretary for government office
You foolish laborer, Nonentity,
you go suffer for nothing

Na that time dem go start dem
Power Show


Na wrong show O

Power Show

Na sad thing
Na bad thing
Na wrong show O

Power na to help your land
Na to help your mates
Na wrong show O

Submit Corrections